Miss Simplicity - Pipu don dey carry tori up nd down sey Jodie Nnaji nd her husband wey dem marry last year October nd wey born their boy pikin for April dis year don blow final whistle for their marriage o nd the mata make many of their fans fear o...
When Punch News hear the tori dem call the Jodie wey be singer o bt she think sey na play o...Now on top the mata, David wey be the husband nd actor don come out come tok sey na lie be the tori wey pipu dey carry about o, sey him nd him wife love still dey kampe and him no ready to leave him wife oo..
Oga David com still tok sey him dey beg pipu sey make dem no dey carry wicked news waka oooo...
Hmmm....na wa o, we dey join oga David to beg una wey dey carry news waka sey make una stop oooo......
Monday, July 25, 2016
NOTHING DO ME ND MY WIFE...OUR LOVE STILL DEY KAMPE...DAVID NNAJI
Sunday, July 24, 2016
(FOTO)SEE WHO THIS DAY STYLE MAGAZINE DEY YARN ABOUT O
Miss Simplicity - Na Charles Oputa wey we knw as Charly Boy wey be veteran singer nd songwriter naim tanda gidigba on top the style magazine wey This Day Magazine bring out o nd man head dey there for d pinshures wey TY Bello take ham oo...
See the foto afta the cut....
SEE WETIN DEY MAKE QUEENETH HILBERT DEY TOK SEY BABA GOD TOO MUCH...
Miss Simplicity - We still dey throway our congratulobia message to our our correct actress Queeneth Hilbert base on sey Baba God o nack her nd her husband one ogbonge blessing dis weekend o...
Queeneth bin don scarce for our screen since wen she marry o bt to make sure sey she no fall her fans hand, she don post d pikin foto for her IG page nd she tok sey to be mama beta pas any other thing for this world o nd she tok sey even though she pass through pain, all of dem vanish wen she see d pikin o.
D actress hapi no be small nd she tok sey she o promise to be beta mama for d new pikin o....
See d mama nd pikin pinshure afta the cut...
(FOTO) OGA ALI BABA GET SWAG NO BE SMALL...
Miss Simplicity - Pipu tok sey wen beauty meet intelligence, e dey bring gud fruit...Na so e be for our ogbonge comedian wey he name be Ali Baba nd ma'am TY Bello o..
D pinshures wey our beautiful TY Bello take our intelligent Ali Baba make sense no be small...The tin bring oga Ali swag come out no be small...
Make e for no lost, oga Ali don sama us wit d pinshures, make una see dem afta the cut...
(FOTO)SONIA IBRAHIM DON YARN PIPU WEY DEY SINGLE CLUB BYE BYE O....
Miss Simplicity - Sonia Ibrahim wey be d younger Sista of Juliet Ibrahim, one of d correct actress wey Ghollywood get, naim don sama her fans with some pinshures wey she take for her wedding wey shele yestaday for East Legion o.
Na last year November her fiance Collins Taabazuing wey be soldier and model sama her wit surprise proposal wen dem two go for dinner o.
Na plenty ogbonge actress like Princess Shyngle, Eddie Nartyey, Pascaline Edwards nd many others naim tanda gidigba for d wedding o nd no be small flenjo shele for there o...
Yes o, we for TPN dey follow una jollificate, jubilate nd celebrate nd we dey pray sey make Baba God guide una ooo...
See some of the pinshures afta d cut....
LAST LAST MONALISA CHINDA DON YARN PIPU HER WEDDING DATE O...
Miss Simplicity - Our ogbonge actress Monalisa Chinda wey she nd her husband Victor Tonye Coker do traditional wedding for February dis year naim don yarn us sey dem don ready to do their white wedding for Greeece o nd sey no family, friends nd colleagues wey she select nd sum gurus wey dey for entertainment naim go tanda for her wedding wey dem wan for for September 1 of this very 2016 o...
Monalisa Chinda tok sey she o dey happy well well o nd we too for TPN dey follow her happy we dey pray sey make Baba God o make He make everything go well for d day wey una pick oooo...
Saturday, July 23, 2016
CONGRATULOBIA AS BABA GOD DON NACK WALE FILANI WITH ONE OGBONGE BLESSING O...
Miss Simplicity - On top pikin mata, Wale wey be rapper naim tori don dey nack our door sey he cancel the show wey he get for One Africa Music Festival wey shele for Barclay Center wey dey NYC base on sey him babe Chloe Alexis wey him don dey befriend tey tey born pikin yestaday for New York afta she don dey labour for 72 hours o...
Wale himself don nack him IG fans pinshure wey show where him pikin Zyla take hold him finger o...
Correct tori, we for TPN dey sey congratulobia to dem oooooo......
(FOTO) KIM KARDASHIAN NO SEND O, SEE HOW SHE DEY ROCK HER FINE SHAPE
Miss Simplicity - Kim Kardashian wey be business woman nd wey don born two pikin naim don sama us wit pinshures wey e be sey she wear turtleneck dress wey show her fine shape o nd she make sense...
I no care wetin pipu dey tok o, I no care weda she dey use body shaper o bt one tin wey I knw be sey d woman knw wetin gud for her o nd me dey appreciate Baba God work for ma'am Kim body oooo...
Carry go ma'am Kim, your head dey there o jare...
Make una see d pinshures afta d cut oo...
(FOTO) SEY NA MARRIAGE MICHELLE DEDE DEY DO ABI NA WETIN MAKE HER DRESS LIKE DIS???
Miss Simplicity - Michelle Dede wey be one lady wey dey popular for media nd wey be TV host naim don sama her fans with new foto wey she dress like Hausa woman wey dey marry o, she fine wella on for d pinshures o nd on top the foto dem she call herself "Amira...
Na so, u make sense for d pinshures sha, keep ham up ma'am....
See d pinshures afta d cut
Tuesday, July 19, 2016
(FOTO) SEE BIMBO THOMAS ND HER PIKIN WEY SHE BORN FOR USA O
Miss Simplicity - Since wey Bimbo Thomas don born her pikin for ogbodo Oyinbo for weekend naim pipu don dey wait for d pikin pinshure o bt d tin scarce like d wey fuel take dey scarce for naija sum times o...
Now Funke Etti wey be ogbonge actress too for Yoruba Nollywood don sama pipu wit d boy nd him mama Bimbo Thomas pinshure nd d tin showcase d way mama dey hapi afta she born o...
Make una see d pinshure wey Bimbo Thomas take sum minutes afta she born her boy pikin o....
(FOTO)BIMBO OSHIN PIKIN MAKE SENSE NO BE SMALL
Miss Simplicity - Bimbo Oshin wey be correct ogbonge actress wey Yoruba Nollywood get naim don sama us wit pinshure wey e be sey she nd her fine pikin wear Iro nd Buba take o nd dem two make sense die for d pinshures like tomorrow no dey o..
No be small tin, Bimbo Oshin na one actress wey no dey carry last for her acting nd dressing o nd if we look d pikin wella we go see sey her head dey there like her mama o, she com still get her mama smile o..I still dey wonder sey who fine pass between mama nd pikin sef, I no knw weda una fit help me o.
Anyway make una see the pinshure afta d cut oo
CONGRATULOBIA CHARLES ANAZODO MARRIAGE DON NACK 13 YEARS OO
Miss Simplicity - Na dis very today naim Charles Anazodo wey be sport analyst marriage to Marian wey be TV broadcaster reach 13yrs nd before now Baba God don bless dem wit two correct ogbonge pikin dem o...
Marian dey hapi like ant wey fall inside sugar naso she kawasaka enta her IG page go post him husband nd her family foto o nd on top ham she write sey o oga Charles na d greatest blessing wey Baba God give her o nd sey she o go love d man forever o...
Na so...we for TPN dey sey congratulobia nd we dey pray sey make Baba God dey continue to dey continue to dey bless una family o..
(FOTO)SEE PIMSHURES WEY ESTHER ENE AUDU TAKE YARN PIPU SEY SHE NO GO TEY MARRY O
Miss Simplicity - We for TPN dey throway salute give Esther Ene Audu as she don nack us wit pinshures to take tell us sey she no go tey kawasaka comot for single pipu club o, she tok sey she don dey ready to marry her fiance Ruff wey be film director wey get Ruff Konz Films for 30th of dis very month wey we dey so oo..
Yes o, we dey follow her pray to Baba God sey wen d wedding day go reach last last, make Him guide dem ooo....
See the pre-wedding pinshures dem afta the cut...



















































