Monday, April 11, 2016

NORFOLK CITY HEAR AM AS TRAIN ACCIDENT SHELE 4 DER AREA

OGINI BERNARD - Dem say accident no dey know anybody na hin make dis one shele for Norfolk city as one train go nack one tractor n trailer as hin dey go. Na 135pipu na hin dey inside d train wey over 6pipu na hin enter injury time as d driver sef dey among. Norfolk air ambulance na hin come resuce some of d Pipu go hopistol as fire enginers n some other emergency services dey background. All d roads wey dey lead to Norfolk frm Cambridge n Norwich shut down cos of d accident

No comments: