Tuesday, December 9, 2014


NA WA O, BOOK WEY COURT SAY MAKE OBJ NO RELEASE DON DEY MARKET  O…WONDERFUL
Dem say make we bone wetin court yarn Prince Buruji Kashamu, the chairman for mobilisation and organisation committee for PDP for South West o, because despite the command wey dem give say make Baba Obasanjo no release him book wey get part 3, wey him call “My Watch” the book don already dey market o.

One of the padis of the former presido don confirm to Sahara Reporters say the story of Obasanjo’s life don already dey market sey sell like akara. He even say very soon dem go start to dey sell am on top the internet where the court power no fit reach.  Dem say OBJ yab we presido no be small for inside the book o, he say presido no get the swagger wey him suppose get to cure the craze wey dey Naija head. Other pipu wey he yab for inside the book na late presido, Alhaji UmaruYar’Adua; former vice presido, Alhaji Atiku Abubakar plus former governors for Delta plus Kwara states, James Ibori and BukolaSaraki, and many more 

No comments: