Sunday, July 24, 2016

SEE WETIN DEY MAKE QUEENETH HILBERT DEY TOK SEY BABA GOD TOO MUCH...

Miss Simplicity - We still dey throway our  congratulobia message to our our correct actress Queeneth Hilbert base on sey Baba God o nack her nd her husband one ogbonge blessing dis weekend o...
Queeneth bin don scarce for our screen since wen she marry o bt to make sure sey she no fall her fans hand, she don post d pikin foto for her IG page nd she tok sey to be mama beta pas any other thing for this world o nd she tok sey even though she pass through pain, all of dem vanish wen she see d pikin o.
D actress hapi no be small nd she tok sey she o promise to be beta mama for d new pikin o....
See d mama nd pikin pinshure afta the cut...

No comments: