This life hard o, make persin just dey do jeje o, no follow anybody quarell sef cos na only God sabi tomorrow. Na yesterday NFF yarn us through dem twitter handle say coach Sunday Oliseh dey feel dizzy dey weak after training on thursday, na so dem advice dem make dem dey rush am go oyinbo UCH wey dey Belgium. You see say no be small mata, the bros no go dey for CHAN game wey dem home based Super Eagles wan play today. Some pipu don dey say na to go beg Enyeama o, no be oyinbo mata o, e fit be African science things o. Toor, Enyeama abeg no vex, forgive am
...lol. We pray say make Baba God take him healing hand touch oga coachie o.
![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjvSm5GkztpfoLTNTr9tJJoQ0S0GWD4ylS7IFpNg9-NgW9D67AIgZQJ7ORpKMaHuQxxFFdBRxej7kD6Ai6cArRhdB1nrEDFzsiysQh-UQY0ONONq5l38a48iUBMsqKrZ8WZGxsR09T2Zqk/s1600-r/HEADER.jpg)
Friday, October 23, 2015
DEM DON RUSH OLISEH GO BELGIUM HOSPITAL OOO....HMMM....ENYEAMA! ENYEAMA!! ENYEAMA!!!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment