Tuesday, July 19, 2016

CONGRATULOBIA CHARLES ANAZODO MARRIAGE DON NACK 13 YEARS OO

Miss Simplicity - Na dis very today naim Charles Anazodo wey be sport analyst marriage to Marian wey be TV broadcaster reach 13yrs nd before now Baba God don bless dem wit two correct ogbonge pikin dem o...
Marian dey hapi like ant wey fall inside sugar naso she kawasaka enta her IG page go post him husband nd her family foto o nd on top ham she write sey o oga Charles na d greatest blessing wey Baba God give her o nd sey she o go love d man forever o...
Na so...we for TPN dey sey congratulobia nd we dey pray sey make Baba God dey continue to dey continue to dey bless una family o..

No comments: