Sunday, July 24, 2016

(FOTO)SONIA IBRAHIM DON YARN PIPU WEY DEY SINGLE CLUB BYE BYE O....

Miss Simplicity - Sonia Ibrahim wey be d younger Sista of Juliet Ibrahim, one of d correct actress wey Ghollywood get, naim don sama her fans with some pinshures wey she take for her wedding wey shele yestaday for East Legion o.
Na last year November her fiance Collins Taabazuing wey be soldier and model sama her wit surprise proposal wen dem two go for dinner o.
Na plenty ogbonge actress like Princess Shyngle, Eddie Nartyey, Pascaline Edwards nd many others naim tanda gidigba for d wedding o nd no be small flenjo shele for there o...
Yes o, we for TPN dey follow una jollificate, jubilate nd celebrate nd we dey pray sey make Baba God guide una ooo...
See some of the pinshures afta d cut....

No comments: