Ibadan no dey carry last na, the thing first start like rumour but na confirmento now say the Oga patapata for UI wey go soon commot as him tenure don expire dey on top batch 2 of ministerial list wey land for senate dommot yesterday. Tori wey dey circulate na him dey confirm say the Oga wey him guy name na IFA. UI pipu just dey happy anyhow plus including dem students say dem Oga go become Minister. Toor make we siddon dey look o, I sha pray make the best happen. I hear say former Oga Gomina for Osun State, Olagunsoye Oyinlola sef dey on top the list.
No comments:
Post a Comment