Wednesday, June 15, 2016

AFTA 10 YEARS, GOD DON CATCH YEYE FAKE DOCTOR FOR ABUJA

Police don catch one yeye fake doctor, Victor Akpan, for Gwarinpa area wey dey Abuja. Tori yarn us say Akpan, don dey run one kain private hospital for 10 years, and na thief he thief certificate wey he take dey work. Tori yarn us say he don do different operation for pipu dey commot fibroid plus dey allow pipu born for him side. Make we no forget say na exactly one year ago dem catch one senior medical officer with the Federal Ministry of Health, Martins Ugwu, by the police sake of say him too dey run things like medical doctor with certificates wey he thief for over nine years. Before dem catch am, dem don first dey shine light for him dommot by the Medical and Dental Council of Naija. We hear say the badt guy na him get Luna Maternity and Surgery Hospital, wey dem open in 2006, with him yeye license wey dem arrange – four years after the MDCN no gree give am licence make he take  practice. The Oga for the pipu wey dey investigate for MDCN, Dr Henry Okwuokenye say dem no give am homeopathic practice licence sake of say the school where he say he for finish for Enugu State, dem no approve am make he train students for alternative medicine.

No comments: