Saturday, October 24, 2015

BADDO NONII...OLAMIDE GO SAMA US ANODA BETA ALBUM DIS NOVEMBER

Na so, King Badoo no dey fall our hand for 5 years now, one year no dey pass without say he sama us one album, many pipu first dey think say him own too mush, he too dey rush but e be like say Olamide no dey slow down, everytin wey pipu dey talk no dey touch am at all and infact he don make up him mind say he no go slow down if Baba God no slow am down. So according to tori wey TPN hear from The NET NG, Olamide don ready to sama us anoda album dis November, efritin don reasy na only title wey dem wan giva am dem never sabi and we still hear say Lil kesh own go drop very soon too. Olamide no hear dem o, dey fire dey go...na your time, sing everything wey dey your head before your time pass. So you go get plenty evergreen like dem KSA wey no dey release album again but dem still dey rock shows for ever.

No comments: