Plateau State Police don catch One guy wey be soldier before, Sunday Umaru, say he kpain him babe after he see some kain text messages on top her phone. Sunday, bin dey the 3rd Armoured Division for the Nigerian Army, but dem attach am to Sector 7 of Operation Save Haven, Jos (OPSH).
Dem say he chuke him babe, Charity Thomas, for Belle for Riyom Local Government Area, and na so she take kpain. Dem say na dis make dem dismiss am from ARMY come hand am over to police for prosecution. When dem dey show him face on Monday, the state Commissioner of Police, Mr. Adekunle Oladunjoye, say na the badt guy invite the babe from Kaduna State to come follow am stay. Na so he come dey check her phone dey see test messages from some other men wey make am vex finish. Na so he carry the vexation kpain the babe. Police say dem dey carry am go court sha.
No comments:
Post a Comment