If you sabi am wella, den you suppose Sabi wetin wan shele on Thursday. Lip Sync Battle na one kain American show wey LL Cool J and Chrissy Teigen dey host and now dem wan come start am for Africa. We own for African, na him dem call Lip Sync Battle Africa and na dis week e dey start on MTV Base Africa ! We own beta pikin D’banj plus South Africa pretty babe, Pearl Thusi go dey host am together and tori yarn us say the thing go sweet no be small. Na dis Thursday e go start for MTV Base Africa by 20:50. I wan see Broda mi Dapo on a different level..... You nko?
No comments:
Post a Comment