Miss Simplicity - Bimbo Oshin wey be correct ogbonge actress wey Yoruba Nollywood get naim don sama us wit pinshure wey e be sey she nd her fine pikin wear Iro nd Buba take o nd dem two make sense die for d pinshures like tomorrow no dey o..
No be small tin, Bimbo Oshin na one actress wey no dey carry last for her acting nd dressing o nd if we look d pikin wella we go see sey her head dey there like her mama o, she com still get her mama smile o..I still dey wonder sey who fine pass between mama nd pikin sef, I no knw weda una fit help me o.
Anyway make una see the pinshure afta d cut oo

Tuesday, July 19, 2016
(FOTO)BIMBO OSHIN PIKIN MAKE SENSE NO BE SMALL
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment