Monday, July 25, 2016

NOTHING DO ME ND MY WIFE...OUR LOVE STILL DEY KAMPE...DAVID NNAJI

Miss Simplicity - Pipu don dey carry tori up nd down sey Jodie Nnaji nd her husband wey dem marry last year October nd wey born their boy pikin for April dis year don blow final whistle for their marriage o nd the mata make many of their fans fear o...
When Punch News hear the tori dem call the Jodie wey be singer o bt she think sey na play o...Now on top the mata, David wey be the husband nd actor don come out come tok sey na lie be the tori wey pipu dey carry about o, sey him nd him wife love still dey kampe and him no ready to leave him wife oo..
Oga David com still tok sey him dey beg pipu sey make dem no dey carry wicked news waka oooo...
Hmmm....na wa o, we dey join oga David to beg una wey dey carry news waka sey make una stop oooo......

No comments: