Saturday, July 16, 2016

SEE WETIN MAKE ANNIE ND TUFACE IDIBIA TOK SEY DEM DEY PROUD OF THEIR PIKIN OOO

Miss Simplicity - Isabella wey be Tuface nd Annie Idibia pikin naim don make her papa nd mama head swell like garri wey dem put inside water on top sey she carry four awards go house from her school graduation party o..
Annie no let d tin cold at all, she sharperly kawasaka enta Snapchat go tell her fans sey her pikin o don make her proud o award as best for Poetry, Diction, Comprehension nd on top all dem give her best behaved oooo...
Hmmm dis one reach make person mama head swell o, carry waka Isabella we for TPN dey pray sey o make God continue to dey help u make u for dey make ur parents proud everytime oooo...
See d pinshures of d award wey mama Annie post afta d cut...

No comments: