The Voters registration wey den just
start on Wednesday for Osun State don turn gobe o as correct bullet don enter 4
PDP members body, and dem dey talk say na APC members drop the bullets for dem
body, for Morroco Ward wey dey Atakumosa West Local Government Area.
When PDP Chairman for the State, Alhaji Ganiyu Ololuwa dey talk he say na APC pipu shoot him pipu o, say na 4 pipu dem shoot and dem wondjure 8 pipu wey dey one hospital now dey collect treatment. He say dem don go report the mata to Police and Department for State Security.
Make e no be like say dem gawk am, the megaphone for APC wey dey Osun, Mr. Kunle Oyatomi don quick talk am say na lie o, no be dem shoot PDP pipu o. He say na PDP pipu dey burst kasala for registration center o, and him just dey imagine wetin go happen for election time if den dey do wahala for only registration like dis. He say e beg police make dem do well make PDP no make pipu run commot from election o.
No comments:
Post a Comment