Thursday, June 2, 2016

(FOTO)SEE PRE-WEDDING PINSHURES WEY DON BREAK NAIJA INTERNET O.


Miss Simplicity - Plenty pipu don com out com comment for pre-wedding pinshures wey one couple sama media with o. D pinshures show one many wey get fiancee wey be plus size o nd dis one don make pipu tok o bt wetin make dis tin dey noteworthy for me be sey I like d lady confidence jare, e no dey easy for sum pipu wey fat to get wetin we dey call "Self Confidence bt I salute dis lady oooo. Carry waka o jare ma'am, ur head dey dia...I salute d many too base on sey him no reason size o nd him follow Sound Sultan word for him music wey he ft Flavor Nabania wey d name be " Orobo" Sultan sey him no go fit carry him orobo o bt sha him go marry her.....  Yes o we for TPN dey pray sey make una wedding day nd una life togeda o make him sweet pas honey... Check out d pinshures nd d comments wey pipu give afta d cut....



No comments: