Wednesday, June 1, 2016

IVORY COAST FIRST LADY BEFORE DON DEY FOR TRIAL ONTOP WAR CRIMES

Ivory Coast's first lady before, Simone Gbagbo, wey be wife of Laurent Gbagbo don enta trial yesterday, as dem accuse am say she do crime against humanity plus other war crimes ontop wetin she do for one civil war wey follow 2010 presidential election wey make about 3,000 people port go heaven. Some pipu wey be Gbagbo supporters, nahin don dey vex say na political pakage plus some rights groups don dey yan say the prosecution too dey rush the mata. Her husband, wey be presido before, Laurent Gbagbo, don already dey before the ICC ontop charges wey dem link to the small kasala wey burst, wey hapun because say hin no gree accept defeat to Alassane Ouattara for one election run-off. Simone Gbagbo nahin don reject the charges plus still con deny say dem get crisis cell for inside dem office as  presido.

No comments: