Monday, June 6, 2016

TOOR...24 HOURS AFTA DEM SAY BUHARI NO SICK, HE DEY GO LONDON FOR TREATMENT

President Buhari don yan say hin ear wahala na hin make am waka go abroad sake of say hin wan go treat am plus say make hin com collet ten-day vacation for London. One press statement wey the Special Adviser, Femi Adesina drop E yan say the presido doctors advised am say make hin waka go abroad for treatment. But make we no forget say when tori first start to dey waka say we presido dey sick, him office come out come polongo say nothing do am O, in fact den say he strong so tey he fit kpain elephant, but sha we pray make God heal am.

No comments: