See gbege O, Freeze of cool FM don follow TB Joshua enter the same trouser on top the bomb wey blow for Brussels O. For one message wey dem shared for Joshua's church TV, Emmanuel TV on January 31, na for there he talk say e Neva finish for one French Country, COS bad guys dey town even as dem don chase dem commot, some of dem still dey and dem wan cos katakata.
He say make dem shine dem eyes well O cos the bad guys dey find where pipu gather, sake of say na plenty pipu dem wan kill. “ But popular OAP Daddy Freeze, no wan hear O, as he climb on top social media go rake for the prophet. He say “Baba, leave story, you no prophesy nada, he say “Northern French country ko, southern Portuguese country ni! Shior!!!”. He say wetin he talk say him forsee kpain 30 pipu, meanwhile 116 pipu kpain for him own dommot. He come advice am say make he none Dat kain level, make he dey predict SureBet for guys make dem take dey hammer!” Make we no forget say Daddy Freeze still dey gbege TB onto the Lekki house wey fall.
No comments:
Post a Comment