One High Court
for FCT wey dey siddon for Wuse Zone
II don give one kain order wey dey stop our former Presido, President Olusegun
Obasanjo say make he no reason am again say he wan publish or wan make another
person publish for am, him own life story wey he take him own hand write wey he
give title, ‘My Watch.’
Na one of the
strong men wey dey PDP for Ogun State, Buruji Kashamu, na him go meet court say
make dem stop Baba with one paper like dat wey Lawyers dey call ex parte
application. Justice Valentine Ashi na him yarn the command on Friday as per
say him gree with wetin Oga Lawyer for Kashamu, Alex Iziyon (SAN), wetin him
gist the court say part of wetin dey inside the book relate to the 20 billion Naira
mata wey the PDP chief, Kashamu don knack for the dommot of former Presido,
OBJ.
The court come
yarn say Baba no go fit publish the book come out until dem finish the mata wey
kashamu gat against am say Baba mis-yarn about am. The Pipu wey sabi do ofofo
wella say wetin dey inside the book get to do with one letter wey Baba Iyabo
wite on December 2, 2013, to |Uncle Jona where he for yarn say dem dey find Kashamu
for crime wey kolobi drug things for the USA.
No comments:
Post a Comment