Wednesday, March 12, 2014

ANOTHER 24BILLION NAIRA DON MISS O, DIS TIME NA FOR POLICE PENSION OFFICE.


Na like electric shock e be yesterday for the House of Rep, Committee on Public Accounts body, wen the Oga for company wey dey see to the waka of retired pipu money, Pension Transitional Arrangement Department (PTAD), Mrs Nellie Mayshak tell dem say dem no get any book where dem for write how 24billion Naira wey dem release from service wide vote in 2010 say make e go Police Pension fund.

Make e for no lost na him make the committee sharply carry dem phone call Aunty Ngozi Okonjo Iweala, wey be Oga minister for money mata and wey dey arrange our economy, plus including Mr. Jonah Otunla, our country's Oga Accountant, Auditor General for Naija, Oga Samuel Ukura, and Oga Director General 1 for our budget office Dr Bright Okogwu say make dem show face come clear the mata o.

Dem come still halla first bank too say make dem show come yarn dem how much dem bin drop for them account. Make e no be like say she koba her sef na him make the madam wey dey open the mata clear dem say na now now she dey enter the office o and den don move the cash before she enter.


The person wey dey monitor cash, Mr Adeyemo Julius Adebolu, say na true  dem collect the money o and him take him church mind advise dem make dem keep the money for first bank and dem keep am, but na only that he know o. how the money take waka from the bank come reach today dem no gist am again.

The chairman, Honouranle Solomon Adeola Olamilekan, come vex say so that kain money dey una account abi, and una wan just dey carry am groove. Say make dem no worry the committee go make sure say dem open the y**sh of the mata.

No comments: