Monday, June 6, 2016

TOOR.... APC SAY NA PDP DEY GINGER NIGER DELTA AVENGERS O

The south south zone of All Progressives Congress (APC) don blame the opposition Peoples Democratic Party (PDP), say na dem dey cause all the gboa gboa ontop oil pipelines for Niger Delta region. The party yan say PDP den do dis wan ontop say den wan dabaru President Muhammadu Buhari government. This yan nahin dey for one gist wey be say na the party leaders from the five states for the south south drop am after den finish one stakeholders meeting for Benin City.

No comments: