Na like yesterday e be o, wen serioius gbege dey happen for
the state of Osun, where muslim students dey wear hijab, Christian Students dey
wear choir robe and traditional pipu dey carry masquerade tins take dey form
level for schools. Now dem don bone kasala and Surutul come do Collabo.
Dem call the collabo concert, Peace and Unity Inter-religious Concept and na one organization wey no be government own, Pax Nigeriana International arrange am for Iwo Town Hall wey dey Osun West Senatorial District. As dem dey sing different songs of unity na so dem dey kukere dey azonto to take follow the music.
Apostle Dipos wey dey coordinate the group say dem arrange the levels take support Ogbeni Rauf Aregbesola for wetin he dey do for the State wey make some pipu dey suspect am say him be religion fantic, say wetin Ogbeni dey try do na to make children of different religion come together, make dem chop and flex together, make unity take dey for the State.
He say if to say this kain arrangement bin dey for North ni, and children from different sides dey mix, there for be no problem like dis kain one wey dey happen now. He say na so dem go carry d mata round the state till e go end for Osogbo on 23 March.
Best of luck, abi no be so?
No comments:
Post a Comment