Monday, May 2, 2016

MAN TALK, WOMAN TALK STAGE PLAY NA TODAY 2ND MAY, 2016

E don tey small wey we dey clear una sat one kain ogbonge stage play go land for Ibadan city. The thing don gather momentum so tey dem do Awoof premiere give press pipu, bloggers etc on 24th of April. Now na today O, the play wey Ola Rotimi write na him my Padi for Radio, Ojobaro Babatunde. Wan gather hand with some other beta theatre guru give life today. Na for arts Theatre, University of Ibadan he go shele by 3pm and 6pm. Gate fee na 1k flat. Make una come see difference between plantain chips and Ipekere, na today you go Sabi say no be only packaging,  even dem taste no be same same. We say congratulobia to Babatunde Ojobaro wey everybody sabi as Mister Rain. No miss am O.

No comments: