Tori yarn us say Skales and him manager Osagie Osarenkhoe don dey police dommot o, sake of say dem do wayo. Everything start yesterday we tori begin dey waka say person wey be Wizkid manager before wey dey manage Skales now, Osagie Osarenkhoe na him dem don call go one police station for Lagos, afta one record company say dem 2 gather thief over N13 million from the company inside 12 months, but Osagie say na lie, no be so. Osage climb Twitter go talk her mind say dem dey try to fall her hand afta she don do dem well, dem wan come spoil her career. Tori say
Skales and Osagie no follow wetin agreement wey dem sign yarn as dem no gree roger the company dem own percentage from money wey pipu take book Skales, na him make dem carry the mata go police. Na Daddy Freeze first confirm say Skales and Osagie don dey police dommot and dem go dey there till police shine light finish on top the mata.
![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjvSm5GkztpfoLTNTr9tJJoQ0S0GWD4ylS7IFpNg9-NgW9D67AIgZQJ7ORpKMaHuQxxFFdBRxej7kD6Ai6cArRhdB1nrEDFzsiysQh-UQY0ONONq5l38a48iUBMsqKrZ8WZGxsR09T2Zqk/s1600-r/HEADER.jpg)
Wednesday, June 1, 2016
POLICE CATCH SKALES AND HIM MANAGER ON TOP 13 MILLA JIBITI
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment