Thursday, March 13, 2014

WE GO DASH UNA 15MILLION DOLLARS, MAKE UNA TAKE ARRANGE BETA ELECTION- USA



Mr. Jeffery Hawkins wey dey represent USA for Naija na him  loud am yesterday wen he dey rub minds with  Journalists yesterday for Oshogbo where he for come do meeting with pipu wey get mouth for election mata for Osun State.

He say USA like Naija well well o, cos we too make sense for dem eye, and na him make dem dey drop 15million dollars (e no even reach 1percent of money wey lost for NNPC) make we take arrange beta election for 2015. He say the money na for political parties, INEC plus including other associations wey dey try make the election make sense. He say dem no go just drop the money o, dem go make sure say dem come supervise the election to make sure say everything pure. He say dem go try use the election for Osun and Ekiti wey go happen dis year take test how the mata go be next year.

He come beg INEC make dem try arrange well well make wahala and gbege no dey during the election, cos if gbege dey and kasala dey burst everywhere e no get as dem go fit arrange election wey make sense. He come promise say dem go also try talk to the political parties plus including other pipu wey get mouth for the mata say make dem try coordinate for the election o, say surutul no get one beta thing wey e go do for dem.


No comments: