Thursday, March 13, 2014

NA LIE O, GUSAU NEVER RETIRE, NA SICK HE SICK O- PRESIDENCY.



Now person no know which one him go believe again o, cos tory wey Sahara Reporters carry yesterday na say Oga Minister for Defence, Aliyu Gusau don resign say e no do again o. Wen the Sahara reporters talk am, dem say the minister say na because say dem top military Ogas
for this country no dey co-operate with am, he go call dem for meeting, dem no go show face and to come spoil everything patapata dem come get mind dey yab him second, Oga Minister for Defence State, Sen. Musiliyu Obanikoro


Dem say the millitary Oga shout for am say make he shut up, who put him mouth for the mata, small boy like am. The report say the Oga Soldier para for dem o, he say dem no go dey take instruction from bloody civilian again. Say na all dis insult plus including disrespect make Gusau decide say him no do again yesterday. How dem go make am Oga wey him go dey fear to talk to pipu wey go work with am.

But sha o, Oga Megaphone for we Federal Government, Dr. Reuben Abati don tell PREMIUM TIMES for phone yesterday say na lie Sahara Reporters dey lie o, say na sick the man dey sick no be say he resign o, say even all the para and yab wey dem say den yab Obanikoro na Super Story o, e never happen. He say na because say Gusau no show for the meeting wey dem ministers dey do with presido every week, make dem dey think am say he don resign, say na sick he sick o.

But rumour wey dey fly dey talk am say Presido don dey send pipu make dem go beg Oga Gusau make him think twice, make he come back to him office.

If na sick or resign, we go soon know, but if na true say e dey sick, make e no gree for the malaria o, make he go drink agbo. We wish am soonest recovery and if na resign we wish am happy retirement.

No comments: