Pikin of one of the before before governors of Oyo state, Kemi Olunloyo, wey like gbege like monkey sey like banana don open her big mouth again talk say e fit be say na Nollywood actor, Jide Kosoko, take him wife wey just kpain, Henrietta do blood money O, sake of say na Henrietta be the number 3 wife wey go die for Jide Kosoko hand. She climb her Twitter go run her mouth, even describe Jide Kosoko as the man wey don bleach him life. She say make dem shine light for him dommot O, cos e be like say him hand no pure for the mata and he fit dey take dem do blood money abi serve other juju. She say dem tell her say dat kain thing common well for inside Nollywood. Incase you dey shock day na which kain person she be, na so so wahala she take dey live her own life. For time wey no too tey she dey yab, Olajumoke, TY BELLO, even she don yab General Overseer of Redeemed Christain Church of God, Pastor E.A. Adeboye when she say Daddy G. O. na murderer.
She say Pastor Adeboye kpain one policeman in 1971. But if you remember say she don first talk say her own Papa, Victor Omololu Olunloyo, dey take juju control dem for him family and she go soon documentary take fall the hand of her yeye Papa, den her mata no go too shock again.
Tuesday, June 7, 2016
KEMI OLUNLOYO SAY JIDE KOSOKO HAND NO PURE FOR THE DEATH WEY KPAIN HIM WIFE O!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)


No comments:
Post a Comment