Wednesday, June 8, 2016

AS E DEY HOT : STEVEN KESHI DON KPAIN AT 54

Dis life sef get as e be, tori wey follow us wake up dis morning dey clear us say Steven Okechukwu KESHI, wey be captain FOR Super Eagles before, still be dem coach before don kawasaka early momo today go meet Baba God for yonder. As of the time wey we dey write dis, dem never Loud wetin kill am, but him family pipu don confirm say true true The Boss don finish him own script go report hin handiwork give Baba God. Na just last year he bury him wife O, wey cancer kpain. We for TPN pray make Baba God be with dem children.

No comments: