Wednesday, September 9, 2015

POLICE DEY FIND A BAD GUY WHO THIEF PIKIN GIVE HIM BABE MAKE SHE GO SELL


Na wo o, Police for Abia State don dey find one bad guy called Uchenna, dem say Uchenna and him padis dem carry gun go collect one 4months old baby from one family for Ntigha Uzo wey dey Obingwa Local Government Area on August 21.

He carry the baby give him girl friend wey dem call Kelechi Uche make she go sell. Na pipu come catch that one for Osusu Aku, the day wey she wan go find person wey go buy the pikin. The baby start to dey cry and she no fit give am bobby suck, na him pipu take suspect am say e be as he get. Pipu make we dey observant ooo.

No comments: