Punch here say if no be for one female teacher wey dey pass
apiam way go school yesterday morning, those badt guys for throw another bomb
for Maryam Babangida Girls Science College for Minna yesterday.
Tori yarn us say the teacher dey run go school ni wen she
smell say persin dey smoke igbo for that area, wen she come try check am out nko
wetin she see na 2 bad guys wey don already wear dem school uniform. Na make
dem wear dem hijab make everything rhyme remain. As dem see am na him dem shout
for am say make she waka far if she no
wan kpain. Na so she take run go the school go raise alarm for students wey don
already dey on top assembly ground wey all of sdem scatter go finds somewhere
go hide dem life before police and military pipu.

No comments:
Post a Comment