Friday, November 14, 2014

NA WA O…ANODA GONFABI DON GO RAPE SMALL GIRL WEY DEY COLLECT TREATMENT FOR TUBERCULOSIS FOR LAGOS O.




Police for Lasgidi don catch one 35 year old Gonfabi ey go rape him neighbor daughter for Bariga area. Tori even yarn us say the 14 years old girl still dey collect 6 months treatment for Tuberculosis wen the yeye neighbor go hayaj am.


The mama of the girl, Mrs Adenike Aderinkomi who be trader yarn punch for dem house wey dey Akilo Street say her daughter go piss ni early momo, wen the badt guy go waylaid am for road o, and the guy no just rape the girl normally o, cos na both front and back he pass enter the girl. The mama say na prayer she dey pray o before she gawk herself and wen she open eye the girl no dey inside, na so dem start to dey find am o before dem later discover wetin happen. She say pipu bin wan woundjure the man make dem do am strong thing but she quickly report the mata to the police make the pipu no go kill am.

No comments: