As per say oil
money don dey fall all over the world, Oga Governor Babatunde Fashola of Lagos
State, yesterday, don dey halla we Federal Government say make dem to reduce
the price of petrol from the N97 per litre wey dem dey sell am na, aftyerall
the price don dey reduce everywhere for the world.
He say as at
last Friday, OPEC don fix the price of oil for $66.27 per barrel. Fashola dey
abuse dem Federal Government say dem no wan adjust the price when he dey yarn
with plenty youths for the Lagos State
and After School Graduation Development
Centre, AGDC, wey dem call IGNITE Employability Project 5 for Ikeja.
No comments:
Post a Comment