E fit no be now o, but one day all of us gats to kpain. But some Naija pipu just get mind say na laff make dem dey laff pipu wey die. Na him make dem dey laff Uncle Alams, wey tori yarn us say heart attack kill am on Saturday, wey he never pass 63years for life. Many dey laff am say na wetin good for am be dat, shebi him chop community money ni. But many dey reason say no mata wetin, we no suppose dey laff persin wey die and na dat one dey cause argument on top facebook. Trust we pipu na, hebdon quick dem dey swear for eachother sef. We pray make Baba God help the family of Alams.

No comments:
Post a Comment