Friday, November 14, 2014

NA WA O…DEM CATCH POLICE MAN WEY DEY COLLECT SALARY FROM 15 POLICE COMMANDS.





Dem Oga for we naija Police don yarn one Federal High Court wey dey siddon for Lagos say dem don catch one police man wey dem bin don even dismiss, Victor Afam Banor, on top say him still dey collect salary from 15 different police commands for naija.


Dem say the guy bin don thief 20 million naira wey dem suppose take pay salary for the Enugu State Police Command, dem say na that one and another car wey police seize wey him thief make dem chase am and even detain am, but the bad guy escape from where dem keep am, come go another place with fake signature say him na DSP. That na why dem dey beg the court say make dem no give am bail o, cos say the guy criminality no be here.

No comments: