Miss Simplicity - Gabriel Afolayan wey be part of d Afolayan entertainment family na one actor wey pipu dey gbadun base on d beta beta film wey him dey do, bt now d guy don kawasaka enta music nd him don dey plan to sama us wit him first album wey he call " Hidden Treasure" nd wen dem ask ham for one interview sey y him call d album dat name...Gabriel tok sey na bcos pipu bin knw ham as actor nd dem no knw sey him get anoda talent for music o, sey d talent dey beautiful o nd pipu neva dey see ham wella o bt as him wan show pipu so naim make ham call d album "Hidden treasure o
Gabriel wey bin don sing " Kokoro Ife nd Awelewa tok sey dis him new album go hit pipu base on sey him take him time prepare ham o...He com still tok sey pipu go see him treasure (music talent) wey him be don dey hide before oooo..
Hmmm I no fit wait to hear d songs wey go dey d album oo.
![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjvSm5GkztpfoLTNTr9tJJoQ0S0GWD4ylS7IFpNg9-NgW9D67AIgZQJ7ORpKMaHuQxxFFdBRxej7kD6Ai6cArRhdB1nrEDFzsiysQh-UQY0ONONq5l38a48iUBMsqKrZ8WZGxsR09T2Zqk/s1600-r/HEADER.jpg)
Sunday, June 12, 2016
HIDDEN TREASURE NA FILM ABI NA MUSIC ALBUM FROM GABRIEL AFOLAYAN?
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment