Thursday, March 3, 2016

NBMA AWARDS NO DEY CELEBRATE PROGRAMME WEY GET BRAIN

Shebi NBMA Awards don come and e don go but Sha O, like every award pipu don dey yarn about wetin dem no like about the award wey dem go like make organizers re-arrange. After the awards,  one of the nominees wey no win release one kain petition on line where he for talk say the categories too much,  the nominees too much,  he even mention name of the organizer,  Mr. kazeem Popoola say the Bros no pure,  he still say na sell dem sell the award to pipu wey get money pass for back stage. But this morning on top dem morning show for Splash 105.5fm wey Ronke Giwa dey anchor na him one of dem popular caller.. Emma Chimo say the award no try cos dem no look side of serious programmes wey get brain like voices plus some others no even get nomination at all. He come beg the organizers make dem no kill radio programmes wey get brain. Toor.... Award for Naija no complete without controversy,  go ask pipu wey dey do Headies. Lol

No comments: