Tuesday, March 18, 2014

GHEN GHEN, CLARK AND AKINJIDE NO GREE FOR DEMSELF O...CONFAB TINZ


As the Confab wey we don too hear about finally start yesterday, Babas for the mata don start to dey disagree o, and the disagreement na from Baba Edwin Clark and another Baba Chief Richard Akinjide.


Chief Edwin Clark believe say na to go back to the 1963 Constitution where Naija for dey practice Parliamentary System of government, and where second government no be state things but regional, him believe say na him go make brain pass but Chief Akinjide say na lie o, the mata no be so, him wan make we go back to the constitution cos say e go fit give muscle to the Federal systen wey we dey practice dey go.

Chief Akinjide even talk am say pipu wey dey talk say make we go back to parliamentary system, dem no know where dey pain dem unto say him wey be Minister for Justice for second republic know as the mata dey go, say one of the reasons wey make dem do this federal mata na Military intervention wey we no want again.  And that constitution go make am say, you no fit become minister anyhow na pipu must vote for you. he sha talk plenty for the mata o.

No forget say the confab just dey start o. So make we cross legge dey see as the mata go be.

No comments: