Oga
speaker for our House of Rep, Hon. Aminu Tambuwal yesterday dey Ilorin for
Kwara State for one public lecture wey Mustapha Akanbi Foundation arrange and
wey dem title; Challenges of Fraud Free Election Under a Democratic Dispensation.
Na former Oga for ICPC, Justice Mustapha Akanbi get the Organization.
Oga Tammbuwal say as the election dey near us, many pipu don dey yarn say if dem no do am well e fit scatter Naija, but he say make Naija pipu go relax our kidney say that kain thing na super story we don pass dat level. He say wether election make sense or e no make sense no fit scatter Naija, na just some pipu wey no dey see pass dem tribe dey always open mouth dey yarn dis kain dust.
He say but election wey no get magomago na him make sense pass and na him we suppose try arrange. He say Federal Government go put better money for INEC pocket if dem wan make dem arrange a better election.
No comments:
Post a Comment