Wednesday, June 8, 2016

EFCC CATCH PLENTY PDP CHIEFOS FOR NORTH EAST NAIJA

EFCC on Monday and Tuesday don catch some Oga for PDP for North-East states of Borno, Adamawa, Yobe plus Gombe.
We hear say dat na part of light wey dem dey shine for the $115m (N23bn) wey tori say the before before Minister for Petroleum Resources, Mrs. Diezani Alison-Madueke, share when we wan do  2015 presidential election. Tori say some pipu like Senator Saidu Kumo, wey be the Special Adviser for Political Matters, to the PDP Chairmo wey dem don commot, Ali Modu Sheriff; plus one before before PDP Chairmo for Gombe State, Paloma Nuhu, don return N2m from dem own share of the money. Some of the pipu wey dem don catch na before before  Minister for Power, Mohammed Wakil (Borno); one former Minister of Science and Technology, Alhaji Abdu Bulama (Yobe); plus the PDP chairmo, Mr. Joel Madaki (Adamawa). The accountant for the Gombe State Government House, Mr. Mohammed Balbaya, na all of dem don dey EFCC dommot say dem collect Roger from Diezani. Somebody say wetin make dem catch dem na bcos those pipu collect like N450m each for dem state. He say wetin make dem catch PDP chairmo for Adamawa State ma bcos he collect N450m.

No comments: