The Director General wey be Oga patapata for NYSC talk on
Thursday, when he dey gist with newsmen for Cross-River, say NYSC go do collabo
with INEC for 2015 election, as per say dem go feature Corpers as electoral
officers for the election matter.
The Oga come warn dem corpers well well say make dem no
reason am say dem wan put hand for magomago during the election. He say na
because say corpers go school well well and dem sgarp enough to handle
electoion materials na him make say demdey use dem for election matter, but
anyone of dem wey demcatch say he dey carry election materials go give
politicians on top say the politicians dey roger am, say the punishment wey dem
go give am go pass the one wey God give satan for garden of Eden.
According to the Oga, he say na NYSC and INEC go
roger the corpers allowee wey make sense for say dem work for the election
matter. he come thank Gov. Liyel Imoke of Cross Rivers State say he do well as
he make security tight for the NYSC camp wer dey Obura for the State. He say demstill dey plan another collabo with
the Central Bank of Nigeria and Bank of industry on how dem go take give osusu
to corpers wey get better business idea (he
be like say man pikin go serve again o
No comments:
Post a Comment