Tuesday, May 17, 2016

WE NO GO GREE O... OYO STATE GOVERNMENT WAN DEY COLLECT MONEY FROM SHOW AND EVENT ORGANIZERS

AFOUDA - Dis tori wey just dey enter we hand now get as e be O, Tori wey reach out hand dis morning from source wey no dey lie dey clear us say Oyo State government don polongo say anybody wey wan do show abi na event for Ibadan, musto first collect permit, make dem pay one kain yeye money before dem go fit. Abeg question wey everybody dey ask be say since dis government enter office who for entertainment dem don epp? Make dem mention one thing wey pipu wey dey arrange shows and events don benefit from dem wey go make dem dey pay government. I no understand O, if petrol no dey sell again for world market, wey dem no see money collect again from federal government, dem tell dem say na we be the winsh wey cause am?  Abeg if dem need money bad bad, make dem think anoda thing O, abi no be place where person plant, e for dey harvest? Cultural center wey suppose open to many pipu for many things dey where una don abandon am put since tey tey, plus including any things. OYO state government suppose sabi say show abi event organizers no owe dem shishi... Cos even reach security na money we take dey hire dem, so wetin we come dey yarn. Make dem no reason am at all O. The we no gree message don dey fly and everybody wey get mouth for the mata don dey yarn say we no gree O.

No comments: