Shebi dem say na over skill dey kill monkey…Den sha don
catch one man o, on top say him babe who don get 7 months old bele kpain for
the hotel wey dem 2 lodge for Onitsha, na so police for Onitsha yarn.
Some pipu dey believe say na the juju abi na otumapo wey her
husband put for her body kpain her, but some still believe say he be like say
na her ghuy man over rod am, and rod am die, but police say dem never see any
body make he come claim say him know the persin wey die and the one wey dem
catch. So dem don carry her dead body go mortuary and the guy dem don hold am
strong while dem still dey shine light for the matter.
No comments:
Post a Comment