Tuesday, May 17, 2016

EDO ELECTION MATA: AGBOMHERE SAY OSHIOMOLE DON FUMBLE

One person wey wan be  governor for Edo State, Mr. Blessing Agbomhere, don halla Governor Adams Oshiomhole, day Make he go beg all dem  national Oga for APC on top say he yab dem. Agbomhere, wey dey fight for governor seat under the aburada of APC for the state talk am for one kain press conference for Abuja on Monday when he dey talk on top wetin dem say the governor yarn when some pipu. wey Olagunsoye Osinkolu carry follow body come from APC. Tori bin yarn say when Oshiomole dey yarn for the pipu wey come, he say no gbege dey shele for inside APC for the State, say make dem national secretariat for the party first dem own internal gbege before dem dey go dey cry like crocodile for Edo State mata. When the man wey wan be Governor dey yarn he say wetin the Governor yarn no suppose come from am at all base in who he be. He say wetin Adams Oshiomhole yarn na to spoil name of dem national secretariat for APC, so dem go fit bone Edo APC, make Oshiomole come turn king, make he dey take by force put him boy for dem head as governor after am. He say person wey Oshiomole wan bring no fit stand near am at all, cos na everything him take pass am.

No comments: