Friday, November 14, 2014

NA WA O, TRADER BEAT HIM CUSTOMER DIE ON TOP SAY BARGAIN NO ENTER FOR LASGIDI





Lasgidi Police don catch one Lawrence Ikonne wey dey sell on top him kpain him customer, Isa Yaya as per say the guy too price wetin he wan buy. Punch metro here say the thing shele for ikonne house wey dey for Afro Close, Afromedia estate, Okokomaiko Lagos.


Tori say na electronics ikonne dey sell for Alaba Market o, na so the 22 year old yaya wey be Aboki follow am go him house o say him wan go buy one second hand Air Conditioner, cos na him own business be that make he dey buy dey resell iron wey don condemn. But wen dem reach house dem gather hand carry the AC commot from inside house and after Yaya price am reach 5000 naira, Ikonne say him no dey go below 5k but Yaya no gree. So Ikonne ask am make he help am carry am enter house back, na so Yaya say na lie o.

Na him refusal vex Ikonne wey make am carry plank whip Yaya for belle o, na so the guy take fall o, as he faint na so Ikonne tie am carry am go corner run commot from house and na so Yaya take die o. Police sha don catch Ikonne and na beg he dey beg o say na vex him vex.

No comments: