Friday, March 18, 2016

SEE HOW GOD TAKE CATCH DEM BOKO HARAM TERRORISTS WEY DEY RUN



The Nigerian Army say God don dey catch dem Boko Haram guys as dem don dey fall enter dem own trap wen military dey do patrol on Wednesday. One statement by Acting Director for army megaphone Colonel Sani Kukasheka Usman say soldiers of 81 Battalion plus 251 Task Force Battalion wey dey for 25 Task Force Brigade on Wednesday pursue some Boko boys Kuala,  COS dem bin go Wayland the soldiers but God pass dem as dem no fit do do thing for we 25 Task Force Brigade. 


After dem clear Dat level na him dem still go off Damboa road from Kumala. Na so dem see say dem Boko Haram car wey get machine gun don go climb bomb wey dem Boko boys bury for ground wen dem dey run. Na so bomb scatter dem and dem car. Na 2 of dem Boko Haram kpain for the mata, we army come still see 1 General Purpose Machine Gun (GPMG), 2 AK-47 Assault Rifles plus one Boko Haram terrorists’ flag, 6 primed IEDs, Anti-Aircraft Gun links plus plenty bullets. Other things na 43 rounds of 7.62mm (NATO) ammunition plus one GSM. He say na God dey catch dem so. 

No comments: