The House of Reps on Monday don beg dem Ogas for NLC make dem bone the strike wey dem dey reason on top subsidy wey Federal Government commot from petrol money. Dat na after dem don first scatter the full house for like 20 minutes, wey some PDP lawmakers no wan make Minister of State for Petroleum Resources, Dr. Ibe Kachikwu show face for inside the house. Labour don dey plan to start strike for midnight on Tuesday (today). The House, wey dem Speaker, Mr. Yakubu Dogara, siddon on top din first gree for one kain meeting like dat say make Kachikwu come yarn dem why government commot subsidy. Na him make the House set up a 10-member ad hoc committee wey go do meeting with dem Labour Ogas within five days to take discuss the mata. The committee, wey Chief Whip for the House, Mr. Alhassan Ado-Dogoa, siddon on top na him dem sama order make dem submit report within 5 days. The House come say afta dem don hear government position, wey Kachikwu explain give dem, dem go like hear from Labour pipu too wetin dem think before dem yarn on top the mata. So house come beg Labour make dem first bone dem strike till dem finish the yarn. Toor.... We never know sha if Labour go gree abi dem no go hear.

No comments:
Post a Comment