Thursday, May 19, 2016

MARIAH CAREY DON DEY READY TO MARRY HUSBAND NO. 3 O

Miss Simplicity - Mariah Carey wey bin don marry two times naim tori dey tok sey she don dey plan to marry anoda husband again o.
Mariah Carey bin marry Tommy Mottola before she marry Nick Cannon wey be d papa of Mariah Carey five yrs old twins Moroccan nd Monroe.
D 46-year-old singer go tie d knot later dis yr nd she tok sey she dey hapi o base on sey  James Packer wey dem two engage early dis yr, na one of d beta tin wey happen to her dis yr o.
Na for d trailer of her new reality TV series wey she call 'Mariah's World naim she take tok sey she dey hapi abt d marriage wey go soon happen o.....
Hmmm na celebrity marriage e go be o.Anyway we for TPN dey sey "Happy married life in advance oooo....

No comments: