Wednesday, February 24, 2016

NAWA O... NAIJA SOLDIERS KPAIN LIKE 9 NAIJA PIPU FOR RIVERS STATE YESTERDAY

Make God come save us for dis kain gbege O, Tori dey yarn us say na like 9 people kpain yesterday, 23rd February, wen kasala burst for Rivers State between we Naija Soldiers and Militants for Bori village wey dey Rivers state Pipu for the area say na revenge the soldiers come do as e be say some militants kpain military pipu for the Area on Monday and say na since Sunday gbege dey shele for the area when some militants go put fire for the office of Senator Magnus Abe who dem talk say he dey work against dem Chairmo, wey everybody Sabi as Solomon Ndigbara aka Solo. Tori even say one woman wey get Belle die for the mata. Make God sha dey protect us from problem wey we no cause.

No comments: